Friday, 30 August 2019

P&ID no go put leg ontop Nigeria assets - Lai Mohammed

Court or no court oh, oga Lai Mohammed say dem go soon bring out more looters list.Di Nigerian goment say e go do everitin possible to ensure say one engineering firm, Process and Industrial Development Ltd no chop Nigeria assets worth 9.6 billion dollars.

One British court on August 16 bin give di company go ahead to seize Nigeria assets sake of di gbege between dem and goment.

Minister of Information and Culture, Lai Muhammed tell tori pipo say di goment go ensure say e fight di mata to di end and di goment no go lose any of im assets to P&ID

E also explain say di ministry of Justice don also launch criminal investigation into di mata to ensure say dem reveal all di mago-mago wey happun during di contract.

"We go appeal di case and defend di right and protect di assets of di pipo of di Federal Republic of Nigeria", im explain.

P&ID say dem enta 20 years contract wit Nigeria Ministry of Petroleum Resources for 2010 to create gas processing plant wey go refine natural gas to lean gas for Nigeria to power dia electric grid.

But las-las, di contract no come gel and di company cari goment go court for di US and UK to demand compensation.

But Nigeria goment say dem go challenge di mata as di company no get any record say dem cari out any project for Nigeria and secondly, di company dey connive wit some Nigerians and foreign pipo to make Nigeria bleed economically.

Police for Kano gbab man wey kill im friend over N40

40 nairaPolice for Kano don confam to BBC Pidgin say dem don arrest Zaharadeen Warawa wey kill im friend Dan Farawa over N40.
Police tok-tok pesin Abdullahi Haruna say dem still dey investigate wetin happun but di report wey dem get show say Zaharadeen come meet im friend to pay am di N40 wey im borrow from am, as di friend say e no get, na im fight start wey lead to death.
"Yes we don arrest am and e dey with us. Di issue na because of N40 wey e tok say e borrow im late friend and as e come collect im money na im fight start wey lead to di death but investigations dey continue."
Jamilu Sani wey be eyewitness for di gbege wey happun tell BBC say dem sit down for joint wia dem dey chat na im Zaharadeen come meet di late Farawa dia ask for im N40, as Isa say e no get, na im fight start.
"Na hand e use hit late Isa hard for belle and e just collapse, from dia pipo rush carry am go Wudil Hospital wia dem confam am dead."
"Di shock of wetin happun still dey with pipo of Warawa Town because e no too tay wey pikin kill im mama for dis same town, so we still dey wonder wetin dey happun." Na so Sani tok.
Killing over small mata na something wey dey happun for Kano. Last month, Kano High Court under Justice Dije Aboki sentence Umar Yakubu to death by hanging after e also kill im friend Ibrahim Adamu afta dem argue over di N20 loan wey e give am.
About two months ago, e get husband wey use pestle hit im wife to death just because he ask her to enter room go bring something and she no gree go.
Also for di same Kano for March dis year, Abdullahi Haruna stab im friend Mujitapha Musa to death, afta two of dem dey argue about El Classico match between Real Madrid and Barcelona wey just end.
Di police tok tok pesin say, authorities dey very serious about community policing to handle tins before e turn something else.

Thursday, 29 August 2019

We 'close' Seme border to fight smuggling - Buhari

Nigeria President Muhammadu Buhari and Benin Republic President Patrice Talon for TICAD7 summit for Japan

Nigeria President Muhammadu Buhari say di reason for di partial closing of Nigeria border with Benin Republic na sake of di massive smuggling activities, especially of rice, wey dey happun for dia.

Buhari give di reason during im tok-tok with di President of Benin Republic, Patrice Talon, during di Seventh Tokyo International Conference for African Development (TICAD7), wey dey happun for Yokohama, Japan on Wednesday.

President Buhari, wey express great concern ova di smuggling of rice, say e dey threaten wetin e administration done achieve with dia agricultural policies.

According to am, "Now wey our people for di rural areas dem dey go back to dia farms, and di kontri don save money wey dem for spend to dey import rice with di kontri scarce foreign reserves, we no fit allow smuggling of di product on large scale like dat to continue."
The Nigerian President say di limited closure of di kontri western border na to allow Nigeria security forces develop strategy on how to fight di smuggling.

Presido Buhari wey dey respond to di concern wey President Talon raise ontop how im pipo dey suffer because of di closure say im don take note and e go consider make dem open am again in di nearest future.

Buhari add say im go soon call meeting with im colleagues dem from Benin and Niger Republics to decide correct policies to stop di kain smuggling wey dey happun for di border.

FBI list: EFCC go collabo wit US authorities to torchlight Nigerian yahoo-yahoo

Pesin dey look computer laptop and phone

Nigeria corruption police EFCC say dem dey torchlight di pipo wey America goment accuse of yahoo-yahoo, wey dey hide for di kontri, tori pipo News Agency of Nigeria dey report.

EFCC oga for Ibadan, south-west Nigeria, Friday Ebelo, say im agency dey do collabo wit Federal Bureau of Investigation (FBI) to gada information on di nearly 80 Nigerian suspects.

Oga Ebelo say di operation na to know di kain leg work wey di pipo wey dey Nigeria dey epp di US-based suspects to do across di kontri.

E say some of di information wey dem gada na im make dem catch one ogbonge yahoo-yahoo suspect, Ajayi Gbenga Festus, wey dem accuse say don make up to N75m dis year alone and wey over N223 million of mago-mago moni done enta im Nigerian bank account.
EFCC office for Ikoyi, Lagos

EFCC believe say Festus na di main pesin wey dey epp di suspects abroad to collect moni for Nigeria.

Dis year alone, EFCC say for Ibadan zone dem don nab 263 suspects for yahoo-yahoo and out of dem get 111 convictions.


Bashir Ahmad delete claim say police rescue kidnap victims

Nigeria policePresido Muhammadu Buhari special assistant on digital media, Bashir Ahmad, don remove one Tweet wia im claim say Nigeria police rescue three university students wen bad pipo bin kidnap.
Di police tok-tok pesin for Kaduna state police, Yakubu Sabo, bin tell BBC Pidgin on Wednesday say dem secure di release of di students and dem don unite dem wit dia families.
Na dat same tori say police get hand for di release of di girls wey dem bin kidnap on Monday for di Abuja-Kaduna road oga Ahmad come post for Twitter, but don delete now.
Bashir tweet
For wetin im post as to why im delete di tweet wey say police rescue di girls, im say na based on information im get from di girls families:
One Sadiq Ango na im be one of those wey bin first react to Ahmad tweet as im say dem negotiate wit di "kidnappers to secure di release of our sister to us not di police":
Sadiq tell BBC Pidgin say one of di girls na im cousin and say "no police involve for di negotiations and di release."
"Di ransom na for Rijana town we pay am and dem release di captives to us wia dem waka several kilometres before our family members wey dey search for dem see dem," im add.
Also, two tweets from dis users also attack wetin di presidential aide tok about how di students take free:
But Kaduna police tok-tok pesin, Yakubu Sabo, don clarify to BBC Pidgin say police no "directly" involve for di release of di girls.
Im say na six pipo dem bin kidnap and say police sharp intervention force di kidnappers to release di first three pipo wey bin dey dia hand.
"Police no go fit negotiate wit criminals, all we fit do na to see say we fit do anything e go take to release dem.
"Police no go fit stop family to negotiate, but dat no go stop us to do our own work.
Im add say police don dey involved for di operation since di beginning and say pesin no go fit minus di work wey police do for di release.
Kidnapping for ransom dey happun wella across Nigeria and some victims and dia families don come out to tok how much dem pay for dia release.
Nigeria police dey sometimes tok say dem don rescue victims, but dem no dey tok di role wey di family play to secure di release.


Wednesday, 28 August 2019

Why dis area for Nigeria dey get 24 hours light

Power official
Di Ikeja electricity company wey dey supply light for some areas of Lagos state say if customers ready to pay more, dem go get 24-hours light.

Dis dey come afta tori confam say pipo wey dey live for di Magodo estate of di state, don dey enjoy 24-hours supply since 15 August, 2019.

Felix Ofulue wey be tok-tok pesin for di company say dem get special arrangement wit di estate based on federal goment policy.
Im confam say pipo wey want dis special arrangement gatz ready to "pay more."

"Dem go get dedicated customer service and one team go stand-by to deal wit all dia issues. We dey deal wit organised places at di moment wia e dey easy to sell", im tok.

For pipo wey dey wonda weda dis special arrangement go affect di supply of light to oda areas, oga Ofule say no be so.

"E no get anything to do wit di general supply, e no come from di same source. Plenti investment don enta Magodo for dat kain thing to fit happun.

"For instance, evribodi for Magodo get meters and oda tins like transformers dey.

"We dey also meet oda customers and we dey hope say by di time wey many of dem get meters, power supply go improve."

Though im no gree tok exactly how much di residents of di estate dey pay, some pipo wey dey live for di area tok for Twitter say dem dey pay double wetin odas dey pay.

For May 2017, Nigerian goment bin introduce policy wey make am possible for groups to fit buy power on special arrangement and pipo bin hail di move as correct one.

Nigeria don reduce visa fee for Americans

US Embassy Abuja
Nigeria goment don reduce visa fees for American citizens wey wan travel come Nigeria.

Dis one dey come after America announce yesterday say Nigerians go pay wetin dem call visa issuance fee in addition to di regular visa fee wey dem gats pay. Dem tok say na sake of say di total cost for U.S. citizen to obtain visa to Nigeria currently high pass di total cost for Nigerian to obtain dat kain visa to di United States.

Di visa reciprocity fee as dem call am na to close di gap.
For statement wey di Federal Ministry of Interior release dem tok say dem don dey engage America embassy on di mata before and dem even set up committee to conclude on di mata. Dem add say di committee don even submit report but na di transition process for di ministry na im delay di process.

Di Minister of Interior, Rauf Aregbesola don tok say make dem reduce di visa fee as di committee don recommend. Nigeria Immigration Service go start to dey implement di new fee wey be USD 160 from di 29th August, 2019.