Showing posts with label Muhammadu Buhari. Show all posts
Showing posts with label Muhammadu Buhari. Show all posts

Thursday, 29 August 2019

We 'close' Seme border to fight smuggling - Buhari

Nigeria President Muhammadu Buhari and Benin Republic President Patrice Talon for TICAD7 summit for Japan

Nigeria President Muhammadu Buhari say di reason for di partial closing of Nigeria border with Benin Republic na sake of di massive smuggling activities, especially of rice, wey dey happun for dia.

Buhari give di reason during im tok-tok with di President of Benin Republic, Patrice Talon, during di Seventh Tokyo International Conference for African Development (TICAD7), wey dey happun for Yokohama, Japan on Wednesday.

President Buhari, wey express great concern ova di smuggling of rice, say e dey threaten wetin e administration done achieve with dia agricultural policies.

According to am, "Now wey our people for di rural areas dem dey go back to dia farms, and di kontri don save money wey dem for spend to dey import rice with di kontri scarce foreign reserves, we no fit allow smuggling of di product on large scale like dat to continue."
The Nigerian President say di limited closure of di kontri western border na to allow Nigeria security forces develop strategy on how to fight di smuggling.

Presido Buhari wey dey respond to di concern wey President Talon raise ontop how im pipo dey suffer because of di closure say im don take note and e go consider make dem open am again in di nearest future.

Buhari add say im go soon call meeting with im colleagues dem from Benin and Niger Republics to decide correct policies to stop di kain smuggling wey dey happun for di border.

Bashir Ahmad delete claim say police rescue kidnap victims

Nigeria policePresido Muhammadu Buhari special assistant on digital media, Bashir Ahmad, don remove one Tweet wia im claim say Nigeria police rescue three university students wen bad pipo bin kidnap.
Di police tok-tok pesin for Kaduna state police, Yakubu Sabo, bin tell BBC Pidgin on Wednesday say dem secure di release of di students and dem don unite dem wit dia families.
Na dat same tori say police get hand for di release of di girls wey dem bin kidnap on Monday for di Abuja-Kaduna road oga Ahmad come post for Twitter, but don delete now.
Bashir tweet
For wetin im post as to why im delete di tweet wey say police rescue di girls, im say na based on information im get from di girls families:
One Sadiq Ango na im be one of those wey bin first react to Ahmad tweet as im say dem negotiate wit di "kidnappers to secure di release of our sister to us not di police":
Sadiq tell BBC Pidgin say one of di girls na im cousin and say "no police involve for di negotiations and di release."
"Di ransom na for Rijana town we pay am and dem release di captives to us wia dem waka several kilometres before our family members wey dey search for dem see dem," im add.
Also, two tweets from dis users also attack wetin di presidential aide tok about how di students take free:
But Kaduna police tok-tok pesin, Yakubu Sabo, don clarify to BBC Pidgin say police no "directly" involve for di release of di girls.
Im say na six pipo dem bin kidnap and say police sharp intervention force di kidnappers to release di first three pipo wey bin dey dia hand.
"Police no go fit negotiate wit criminals, all we fit do na to see say we fit do anything e go take to release dem.
"Police no go fit stop family to negotiate, but dat no go stop us to do our own work.
Im add say police don dey involved for di operation since di beginning and say pesin no go fit minus di work wey police do for di release.
Kidnapping for ransom dey happun wella across Nigeria and some victims and dia families don come out to tok how much dem pay for dia release.
Nigeria police dey sometimes tok say dem don rescue victims, but dem no dey tok di role wey di family play to secure di release.