Showing posts with label America. Show all posts
Showing posts with label America. Show all posts

Thursday, 29 August 2019

FBI list: EFCC go collabo wit US authorities to torchlight Nigerian yahoo-yahoo

Pesin dey look computer laptop and phone

Nigeria corruption police EFCC say dem dey torchlight di pipo wey America goment accuse of yahoo-yahoo, wey dey hide for di kontri, tori pipo News Agency of Nigeria dey report.

EFCC oga for Ibadan, south-west Nigeria, Friday Ebelo, say im agency dey do collabo wit Federal Bureau of Investigation (FBI) to gada information on di nearly 80 Nigerian suspects.

Oga Ebelo say di operation na to know di kain leg work wey di pipo wey dey Nigeria dey epp di US-based suspects to do across di kontri.

E say some of di information wey dem gada na im make dem catch one ogbonge yahoo-yahoo suspect, Ajayi Gbenga Festus, wey dem accuse say don make up to N75m dis year alone and wey over N223 million of mago-mago moni done enta im Nigerian bank account.
EFCC office for Ikoyi, Lagos

EFCC believe say Festus na di main pesin wey dey epp di suspects abroad to collect moni for Nigeria.

Dis year alone, EFCC say for Ibadan zone dem don nab 263 suspects for yahoo-yahoo and out of dem get 111 convictions.


Wednesday, 28 August 2019

Nigeria don reduce visa fee for Americans

US Embassy Abuja
Nigeria goment don reduce visa fees for American citizens wey wan travel come Nigeria.

Dis one dey come after America announce yesterday say Nigerians go pay wetin dem call visa issuance fee in addition to di regular visa fee wey dem gats pay. Dem tok say na sake of say di total cost for U.S. citizen to obtain visa to Nigeria currently high pass di total cost for Nigerian to obtain dat kain visa to di United States.

Di visa reciprocity fee as dem call am na to close di gap.
For statement wey di Federal Ministry of Interior release dem tok say dem don dey engage America embassy on di mata before and dem even set up committee to conclude on di mata. Dem add say di committee don even submit report but na di transition process for di ministry na im delay di process.

Di Minister of Interior, Rauf Aregbesola don tok say make dem reduce di visa fee as di committee don recommend. Nigeria Immigration Service go start to dey implement di new fee wey be USD 160 from di 29th August, 2019.